Audio By Carbonatix
French Presido Emmanuel Macron don announce say eight West African kontries wey dey use CFA franc as moni go begin use ECO as di new currency starting from year 2020.
Di West African CFA franc wey pipo sabi as 'franc cefa' na di legal currency for Benin, Burkina Faso, Guinea-Bissau, Ivory Coast, Mali, Niger, Senegal and Togo.
Di French goment bin introduce di CFA franc to dia colonies for West Africa for 1945 and na dis same currency wey get links to di former colonial masters for France, dis West African kontris still dey use until now.
Ivory Coast Presido Alassane Ouattara admit say di CFA franc na symbol of colonialism.
President Ouattara wey tok dis one for di kontri capital Abidjan, announce three major tins wey go change wey include change of name, bye bye too holding of 50 percent of di reserves for di French treasury and dem go also comot di French goment mouth from anytin wey consign di new currency.
Macron throway tuale give di changes as im add say, "Eco go see di light of day for 2020".
Na since six months dem don dey plan di deal.
Meanwhile, di Economic Community of West African States dey also ginger all di oda kontries wey be dia members to join dis move to begin use di same Eco currency by 2020.
But kontris like Nigeria neva fit meet di criteria to begin use Eco sake of tins like high inflation rate and heavy gbese.
Economists dey also warn say di move fit no dey good for Nigeria.
DISCLAIMER: The Views, Comments, Opinions, Contributions and Statements made by Readers and Contributors on this platform do not necessarily represent the views or policy of Multimedia Group Limited.
DISCLAIMER: The Views, Comments, Opinions, Contributions and Statements made by Readers and Contributors on this platform do not necessarily represent the views or policy of Multimedia Group Limited.
Latest Stories
-
Trump media firm to issue new cryptocurrency to shareholders
3 minutes -
Police restore calm after swoop that resulted in one death at Aboso
18 minutes -
Bawumia calls for NPP unity ahead of 2028 elections
26 minutes -
Fifi Kwetey brands calls for Mahama third term as ‘sycophancy’
37 minutes -
‘Ghana’s democracy must never be sacrificed for short-term politics’ – Bawumia
41 minutes -
Bawumia congratulates Mahama but warns he “cannot afford to fail Ghanaians”
42 minutes -
Ebo Noah arrested over failed Christmas apocalypse and public panic
1 hour -
CICM backs BoG’s microfinance sector reform programme; New Year Debt Recovery School comes off January-February 2026
2 hours -
GIPC Boss urges diaspora to invest remittances into productive ventures
2 hours -
Cedi ends 2025 as 4th best performing currency in Africa
2 hours -
Obaapa Fatimah Amoadu Foundation launches in Mankessim as 55 artisans graduate
3 hours -
Behold Thy Mother Foundation celebrates Christmas with aged mothers in Assin Manso
3 hours -
GHIMA reaffirms commitment to secured healthcare data
3 hours -
John Boadu pays courtesy call on former President Kufuor, seeks guidance on NPP revival
3 hours -
Emissions Levy had no impact on air pollution, research reveals
4 hours
