Audio By Carbonatix
French Presido Emmanuel Macron don announce say eight West African kontries wey dey use CFA franc as moni go begin use ECO as di new currency starting from year 2020.
Di West African CFA franc wey pipo sabi as 'franc cefa' na di legal currency for Benin, Burkina Faso, Guinea-Bissau, Ivory Coast, Mali, Niger, Senegal and Togo.
Di French goment bin introduce di CFA franc to dia colonies for West Africa for 1945 and na dis same currency wey get links to di former colonial masters for France, dis West African kontris still dey use until now.
Ivory Coast Presido Alassane Ouattara admit say di CFA franc na symbol of colonialism.
President Ouattara wey tok dis one for di kontri capital Abidjan, announce three major tins wey go change wey include change of name, bye bye too holding of 50 percent of di reserves for di French treasury and dem go also comot di French goment mouth from anytin wey consign di new currency.
Macron throway tuale give di changes as im add say, "Eco go see di light of day for 2020".
Na since six months dem don dey plan di deal.
Meanwhile, di Economic Community of West African States dey also ginger all di oda kontries wey be dia members to join dis move to begin use di same Eco currency by 2020.
But kontris like Nigeria neva fit meet di criteria to begin use Eco sake of tins like high inflation rate and heavy gbese.
Economists dey also warn say di move fit no dey good for Nigeria.
DISCLAIMER: The Views, Comments, Opinions, Contributions and Statements made by Readers and Contributors on this platform do not necessarily represent the views or policy of Multimedia Group Limited.
DISCLAIMER: The Views, Comments, Opinions, Contributions and Statements made by Readers and Contributors on this platform do not necessarily represent the views or policy of Multimedia Group Limited.
Latest Stories
-
African negotiators seek delivery of climate commitments at COP31
1 minute -
BoG develops AI rules for financial sector
3 minutes -
‘Big Push’: Government assures contractors of prompt payments
7 minutes -
Court fines miner for breaking into gold buying shop
17 minutes -
Tarkwa court jails labourer for three years over GH¢123,000 theft
1 hour -
GAEC must retain nuclear scientists for Ghana’s nuclear ambitions – Minister
2 hours -
Man reportedly mistaken for game and shot by hunter dead in forest
2 hours -
19-year-old mason jailed 15 years for defiling seven-year-old pupil
2 hours -
Ghana’s banking sector assets rise 20.47% to GH¢500.2bn – BoG Governor
2 hours -
22 injured as Sprinter bus overturns at Sege after tyre burst
2 hours -
UN housing expert urges Ghana to strengthen Rent Control Department amid housing affordability concerns
2 hours -
Delta-BCI partnership reaches 166,000 people with breast cancer education
2 hours -
Power restoration fault suspected in Kumasi Central Market fire
7 hours -
The 7-foot giant of Ngleshie Amanfro: Seven-foot Ghanaian Ephraim Saawa dreams of joining the national basketball team
8 hours -
Government promises support for Kumasi Central Market fire victims
8 hours